THIS WEEK WITH FUNKE COLE

 


Mr Chairman,

Accurate time keeper,

Impartial panel of judges,

My able Friends,

Fellow Co debaters

All protocols duly observed.

My name is my name, and I am here to propose the notion that ...

 

"Nobody senior another person for this life, life na turn by turn".��� ���️���️���️������️ ��� ������️

 

With the following reasons:

 

1. Dem first born you no mean say na you go first die. Even Bible support am.

 

2. If you first me touch ceiling because you tall, I go first you to pick stone for ground because i near ground pass u

 

3. You fit first me enter SS1 and I fit first you enter university.

 

4. My jeep fit stop for road while your Beetle fit carry you reach house.

 

5. Girl wey marry last year fit born pikin before woman wey marry 10 years ago.

 

6. Small boy wey just finish school fit begin work before chairman wey do NYSC 2015

 

7. If aeroplane engine knock, both person wey dey first class and the one for economy, na the same Jesus dem go call.

 

8. Na Oga de pay driver, but AC de first blow driver before e reach oga for back.

 

9. Person wey de healthy fit die before person wey de sick.

 

10. You de stay upstairs no mean say you near God pass.

 

11. Stone de scatter water, and water de pieces stone.

 

12. When you see me na when I see you.

 

I hope with these few points of mine, I have been able to convince and not confuse you that "No body senior another person for this life. Life na turn by turn. This life Nor balance at al.

 

Thank you!������������������������������������������������������������������������������������




Funke Cole writes from Lagos Nigeria

Comments